After the trending VeryDarkMan video where him dey address Bobrisky leaked voice recording, Folarin Falana AKA Falz don sue VDM.
E be like kasala wan burst today as plenty issues dey sup for VDM. Falz wey be musician and son to Barr. Femi Falana (SAN) don hammer VDM one long letter.
Falz or Falz de Bad gug as people de call am, na activist and musician wey don sing songs against plenty things wey the sup for this country.
24 hrs @thatverydarkman @thatverydarkmnn pic.twitter.com/JjcRo0Y6nn
— Bop Daddy (@falzthebahdguy) September 25, 2024
With the video wey VDM release Wednesday, plenty people dey question if true true, him de really fight against corruption or na just eye service him de do.
Na him Falz decide respond to the video with letter from him legal team.
Inside the letter, him give VDM 24 hours make him withdraw the things wey him talk about am, give am public apology or face the law.
This whole issue happen because of the allegations wey VDM put forFalz head sey him de support Bobrisky make justice no prevail.
Sey the allegations na against him public image and if him no withdraw am, them go carry the case go court.