Dese fashion tips go help you package yourself in a way people go think sey you be Otedola pikin, even if sapa hold you for neck.
People wey like to maintain steeze sabi sey drip dey very important and na why you no go ever catch them unfresh.
For this article, we go share some fashion tips wey go help you slay on top small money:
Tip 1: Good grooming
Good grooming mean sey, make you dey take good care of your body. Make sure sey your hair dey clean, cut your nails if you be man and if you be woman, make your nails dey always shine. And make your skin no get krokro on top. Try de use perfume make you de smell nice. Even if no be expensive perfume, make e sha smell nice.
Tip 2: Wear neutral colours
Colours de affect person drip. No be every colour go fit your skin. If you no sabi the colours wey fit your skin, wear neutral colours like black, grey, brown and white. This neutral colours go help you well well even when you no sabi wetin to wear.
Tip 3: Buy versatile clothes
Buy clothes wey you fit use for different occasions and you fit combine with different accessories.
Tip 4: No forget your shape
Because cloth fit your friend no mean sey e go fit you, wear clothes wey fit your body and size. Some clothes de hide shape, and some go hold your body well well.
Tip 5: Find tailor wey sabi work
Find Tailor wey sabi him work and wey no de disappoint. So that if you buy cloth wey big pass you, him go reduce am to your perfect size.
Tip 6: Accept clothes from friends
You know sey life na packaging, and if you package yourself well nobody go sabi sey you broke. Na the same thing with a accepting clothes wey people dash you. Nobody go know sey na dash them dash you.
Tip 7: Use accessories
This na the easiest thing wey dey give life to boring clothes. Use things like earrings, rings, wristwatch, belts, eyeglasses or scarf to up your dressing game.
But if you dey use these accessories, remember sey less is more, if you combine them too much them no go make sense.
Las las, who no know no know, life na packaging, if you package your sapa well, you fit de impress who guide pass you.