Argument between FC and 30BG no go ever end because all the fans believe sey na their Idolo dey top. But many other artists sef mount for highest paid Nigerian musicians in 2024.
Na why we compose this list of highest paid artists in Nigeria and their net worth.
Highest paid Nigerian musicians in 2024
1. Davido: Net worth $90 million
30BG leader and self acclaimed 001 naim dey top of the list of highest paid Nigerian musicians in 2024. With the kain doings wey him dey do for internet, no be new thing sey na him lead this list.
2. Wizkid: Net worth $70 million
Biggest bird na the second highest paid Afrobeats artists with net worth of $70 million.
3. Don Jazzy: Net worth $55 million
Don baba Jay na the third richest artist for Nigeria. Even though w no de too perform again, him record label Mavins de drop hits back to back wey de put on top of richest Nigerian artists.
4. Burna Boy: Net worth $55 million
Oluwa Burna AKA Odogwu na the fourth highest paid Nigerian musician in 2024. E no too clear how much hom de charge per performance but him doings sef choke.
5. Timaya: Net worth $35 million
Ikperi mama 1 of Bayelsa, Timaya sef no small. The singer na the fifth richest Nigerian musician.
6. D’banj : Net worth $30 million
Koko master Oladapo Daniel Oyebanjo alias D’banj na the sixth richest artist even as him no de too show himself again, him money long.
7. 2 Baba: Net worth $27 million
African Queen singer, 2 face idibia no de too make noise because him money dey speak for am. 2 baba na the seventh richest Nigerian musician.
8. Olamide: Net worth $21 million
Olamide baddo and one of the top pioneers of Yoruba indigenous rappers sef show for this list as the eighth richest artist.
9. Phyno: Net worth $20 million
E no dey surprising sey Phyno dey this list. De guy na low-key star wey no dey make noise but im music dey make brain and he dey get plenty endorsement deals.