Jege meaning

Oyibo man and woman

Jege na Nigerian slang, people wey dey use street language go sabi am because e no too popular but e still dey.

Jege na another word for cap or whining. When person talk sey you de cap, mean sey wetin you de talk no get head, or e no gel.

But jege get e own meaning. And e mean sey, na whining. And if you de whine person e mean sey you wan use their head. Sey wetin you de try talk no be true but e sweet to hear.

Some boys dey use whining toast girl. Even if them no like her, them go hype am make her head big, she go come fall for their lamba.

That kind whining now na jege. And how them de use am for sentence be like exclamation.

Like now if person talk sey fuel price go reduce to ₦150/litre, na jege. Na serious whining because as things dey go, e fit no happen

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *