Nigerian music superstar, Timaya recently post pictures of him new partner and some Nigerians con describe her as Akata.
Even before di singer post him new lover, di name Akata don already dey in existence even though na once once people dey use am.
Singer Timaya shares stunning photos with his new "boo," American reality star Brooke Bailey.
.
.
Timileyin Ajayi Veekee James Agege Opay BREAKING NEWS NIBSS Lungu Sabinus Alausa pic.twitter.com/5Wec83y8az— Gboah Tv (@Officialgboahtv) January 13, 2025
In this article we go discuss wetin Akata mean and how them dey take use am.
Meaning of Akata
Akata na slang wey Nigerians dey use describe Black Americans, especially their women.
Akata dey like Oyinbo, only that, them no de represent the same thing. While oyinbo na name for white people or very fair people, Akata na name for Black Americans or Nigerian American women wey base for abroad.
Uses of Akata
Na where di while matter dey interesting be this. As earlier mentioned, even though oyinbo and Akata na both names for foreigners, them represent different things.
Oyinbo na simple name wey no get deep meaning, but Akata na troublesome name.
Generally, some Nigerians believe sey Black Americans, especially their women get pepper body and their wahala too much and na why them de call them Akata, (which also means witch) be that.