Meaning of Aura for Aura

Aura for Aura banter

Aura for aura, or band for band na social media trend wey don dey low-key. Even as e don tey small for social media, na just recently many people begin use am.

As the slang come de gain popularity, some people de wonder wetin aura for aura mean and how them go fit use am for sentence.

Meaning of Aura for Aura

Aura for Aura or band for band na another way to talk sey, an eye for an eye, or a tooth for a tooth.

Millennials go talk sey na “do me I do you, God no go vex”. As Gen Z come de bring out more Nigerian slangs, them come tush this one up come de call am aura for aura.

Social Media Use

One very sweet example of how them the use aura for aura na the vawulence wey just happen between South Africans and Nigerians for X.

Based on wetin sup, South Africans first decide sey them wan frustrate Nigerians, them come order bolt for their country come cancel am.

Na so Nigerians sef talk sey them no go gree for anybody, them sef go do their own back. Nigerians come go de order bolt for South Africa come de cancel am too. This kind gbas gbos situation naim them the call aura for aura.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *