Delulu na short way of writing Delusional. No be for Naija e come out from, but Nigerians sef de follow use am well well.
Meaning
Delulu mean sey when person no want face reality. People wey de imagine things wey no fit sup, or no de sup na people wey dey delulu.
NLC demanding for #400k minimum wage na clear case of delulu because e fit sup for Naija.
For social media, them de talk sey, delulu is the solulu, meaning delusion is the solution.
let me be a delulu and say that it was joshua who took these pictures… pic.twitter.com/GoyjpQ1hW9
— ayi 🥪✩ (@sandwyhch) August 25, 2024
That is to say that people wey de do Delulu de use am hold body together as the solulu to their problems.
Nowadays if person dey do Delulu, them the advice am make he/she touch grass.
To touch mean sey make them snap back to reality in case them don forget themselves.