Every now and then different slangs and adages de trend for Naija. This year alone we don hear things like “steeze and composure“, “warm eba chop “, “dey play”, “cut soap for me” and “no gree for anybody ” which na the theme of this year.
And just as we de think sey e don end, another one com out sey na gwo gwo gwo ngwo as many people see comedian Brainjotter dance am, e go viral.
And as many people de do di dance dey post for social media, some dey wonder wetin e really mean and how dem go use am shelele.
From Brain Jotter to the world – meet the brain behind the Gwo Gwo Ngwo dance trend, thanks to Mike Ejeagha's classic song! Follow us for more. 🌍🔥 #GwoGwoNgwo #MikeEjeagha #DanceChallenge #BrainJotter #IgboHighlife #NigerianContentCreator #AfricanContentCreator #NigerianMusic pic.twitter.com/ZVIdGBtSET
— The Alkebulan Trust (@Alkebulan_Trust) July 26, 2024
What Gwo Gwo Gwo Ngwo means
Gwo gwo gwo ngwo na part of lyrics to one song titled Enyi Naga by Mike Ejeagha a veteran singer. And gwo gwo gwo ngwo na di part wey dey demonstrate di victory dance of tortoise for inside di story wey this song dey tell.
This song start to dey trend for many comedy skits but many people come dey use am for inside statement. Dem dey use am when di talk no too make sense.
For example, if person dey lie give you, you fit tell am gwo gwo gwo ngwo, that one now go mean sey you no believe or di story no make sense.
Other times when dem de use di gwo gwo gwo ngwo na when water wan pass garri. Like when dia is a gbas gbos situation where two people dey drag demselves.