Meaning of Nsaku in Nigeria

Nsaku slang in Nigeria

Nsaku na person regular name and in fact, na one of di most common surnames be di. According to research Nsaku na di 219,077th most common surname in di world.

You can find people with this name in countries like DR. Congo, Malawi, Uganda and other parts of di world. In Congo especially, 1 in every 44,803 people dey bear Nsaku.

For Nigeria, Nsaku no be just person name, na label and tag, and now e don dey very popular for social media especially Facebook.
So we want explain in details wetin e mean if person call you Nsaku.

Meaning of Nsaku in Nigeria

In Nigeria, Nsaku na name for person wey dey claim relationship with popular, influential or rich person.

E dey normal to find people wey de idolize other people especially when bar dey. These type of Nsaku people dey inherit enemies of di people wey them dey Stan because of how much them want make di popular person acknowledge them.

Di funny thing be sey, sometimes di popular person fit no even sabi sey di other person de exist, even when them sabi, them no too send their papa like that.

So if person call you Nsaku, e mean sey you de do gum body for person wey no send you just so that them go befriend you.

Synonyms of Nsaku

Before Nsaku come out, other words to describe such people don already exist. they are:

  • Gum body
  • FFF(Friends For Food)
  • Foot soldiers
  • Stanners
  • Gbammers
  • Fans
  • Pickme

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *