Meaning of Ojukokoro

Ojukokoro person wants opor money

Ojukokoro na another word for alonga. Whether them call am ojukokoro or alonga, na the same thing them dey talk about.

Meaning of Ojukokoro

For Yoruba, ojukokoro na word wey dey describe person wey dey very greedy or person wey dey do longer throat.

It also means person  wey no wan chop give person and e no want make person chop too.

ALSO READ: Meaning of Sojinu

Na person wey believe sey na only am deserve good things. Like most of our politicians wey de chop money anyhow na ojukokoro de do them.

For Nigerian slangs, ojukokoro no too serious like that as them de use am describe person wey get eye for big things.

Some people go get garri, but their eyes go the chook for their neighbor rice, that kind person get alonga throat. And if you want describe am, you go talk sey ojukokoro de worry am.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *