Every now and then new trends and slangs like OS de come out for Naija, and if you no dey sharp, you fit no sabi wetin de sup.
One of them wey dey trend na OS. If you get many Gen Z for your social media, you fit don come across this slang, and na mostly boys dey use am.
Normal normal, OS for English stand for Operating Systems, which na computer language for tech people. Operating Systems na the software wey computers dey use function.
But for Naija, the meaning of OS dey different from wetin oyibo call am. And na that meaning we wan reveal for here.
Meaning of OS
OS for Naija slangs stand for “Oscroh” or “Olosho”. And Oscroh or Olosho na person wey dey do hookup steady. Them dey exchange knacks for money.
History Of OS
As everything get how e take start, OS also get him history of how e take enter internet.
OS start for one song, “Pepperline” wey Nigerian musician, Crown Uzama AKA Shallipoppi sing.
Shallipoppi na singer wey be leader of “plutomanians” as di Pluto presido. Him don release plenty songs like High Tension, Elon Musk and more.
Shallipoppi songs don motivate many of him fans to bring up slangs like Evian, and OS.
Bro to Bro abeg if you carry OS put for house this weekend no drop code for TL give anybody
— Big Lummy☔️ (@Lummygee1) October 5, 2024
Other names wey get the same meaning with Olosho na, Ashawo, Akunakuna, Hookup, Prostitute.
Now wey you don sabi wetin OS mean, if them don call your babe OS before, e be like na comforter of men you dey date.