Oversabi, ITK or Aproko na names wey them de call person wey like to do sabi sabi. Or person wey like to show sey them know everything.
ITK meaning I Too Know and Aproko na person wey dey do cho cho cho for matters wey no consign them. People wey likely be aje.
Na only Jaido P wan do Olympics Igbo
Na still him wan do Olympics swimming 😂Oversabi wan kpai face of Hiphop 😂 pic.twitter.com/krzVkCTVSk
— 𝕾𝖙. 𝕷𝖔𝖚𝖎𝖘 𝖘𝖚𝖌𝖆𝖗 (@Yincuz_lee) August 14, 2024
So if person na Oversabi person, other names wey them de call them na ITK or Aproko.
Na why Aproko doctor for social media de always get something to talk be that. Because him sabi sey him de always get talk for matters wey consign health, naim him decide name himself Aproko doctor.