Meaning of Rizz

Rizz mode

One low-key Gen Z slang wey dey na Rizz. Just like steeze, this slang na coded slang wey only tush people de like to use

Meaning of Rizz

Rizz na word wey de describe person wey get better toasting game.

To get rizz, e mean sey you sabi shoo shot and e dey enter.

Other people de call am pickup line, but na the old version be that, for Nigeria, Gen Z de call am rizz.

People wey get rizz no de do plenty cho cho cho, na just small tush English wey go burst the girl head.

Rizz and steeze de go hand in hand, e no get as you go get rizz wey you no go get steeze, because the steeze de add to your rizz.

Person wey no tush or get steeze no fit get rizz because, them go talk sey na plenty shalaye you de do.

 

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *