Packaging na normal English word wey get e own meaning and e mean sey when them arrange something well, make e take look good for eye.
The meaning wan take relate to the packaging wey Nigerians de use as Naija slangs.
Naija meaning of Packaging
For Naija people, packaging na slang wey describe your steeze wey make you look good for eye.
The difference between packaging for normal English and Naija slangs na sey, for normal English, them de use packaging take describe objects or items.
But for Naija slangs, packaging na for human beings. And na usually when people de do fake like.
People wey de preach fake it till you make it na them like to package well well, especially girls.
Some of them no go get shishi for their pockets, but them the gaj up pass who get bar.
This fake it till you make it lifestyle dey very popular for cities like Abuja and Lagos sotey some people don believe sey many young men for Abuja na packaging dem de do. If you meet them, them de always look like one alhaji wey de enter Aso Rock, but if you check well, them fit the sleep for their Corolla car, because them no get crib.
Other people de talk sey for Lagos if you no sabi package, e get some kind jobs wey go pass you by. For instance if you de go interview for all this big big companies, even if you no get ride make you borrow ride from one of your guys go for the interview. Sey even if your CV dey correct, them fit reject you based on sey na Keke you carry reach the interview