E get one popular actress wey dem de call Yvonne Jegede wey recently go Nedu Podcast go tok. For di tok, she de support people wey marry two wives, sey e no be bad thing and some people sef wey de tok against marrying two wives, their mama na second wife.
This her tok focus on Yul Edochie and May-yul Edochie marriage, and as di podcast video go round, Nigerians come de insult ham sey she no suppose tok di kind things wey she bin tok as woman wey she be.
Following di heat wey Nigerians give ham, Jegede come write one long apology for her Instagram sey she de apologize to May-yul Edochie and other people wey her tok pain. Sey as woman wey she be she no suppose tok like that.
After her apology, Nedu wey de co-host Di popular Honest Bunch podcast come fire ham. Him post for him Instagram sey if person tok something make dem use their chest tok di thing.
Na wetin him tok be this
“If you talk, use your chest stand by your words”.
Yvonne Jegede come respond give Nedu back. She come de call am names sey Nedu na Narcisstic and toxic man. And as e be like so, she don de believe some kind rumours wey dey Nedu head.
She took sey
“I understand why Nedu no fit understand my apology. Narcisstic and toxic men like him no fit understand di importance of apologizing when wetin you do de pain others, whether you think sey na good or bad”.
She no stop there, she continue sey
“People wey their mind small like you de happy when women de fight. Check Di history of di podcast na so content wey dey against women full am. Nedu, nothing dey wrong sey women de win or shine; e no reduce you or any other man”.