Pastor Adeboye apologizes over controversial tithe statement

Pastor Adeboye of Redeemed Christian Church of God

Head pastor and general overseer of the Redeemed Christian Church of God (RCCG), pastor Enock Adeboye don come out to apologize to him followers sey him misquote the Bible.

Pastor Adeboye been tell him member for 2020 sey, if them no pay tithe, na hell fire straight them go find themselves.

But yesterday, inside one video wey don dey every social media platform, the pastor apologize to him church members sey him dey wrong.

Him tok sey ” I apologize for wetin I tok sey people wey no pay tithe go go hell fire, I am sorry, no be wetin bible tok be that.

Bible tok sey, make everybody dey at peace with all men, and make them maintain holiness, na so them go take see God”.

The 81 years old Daddy GO continue to tok sey, “e dey possible to be right and wrong at the same time. Sey for years we de think sey light de travel in a straight line.

But light de move as waves for one direction. 

It will be wrong to limit people to just 10% of tithe. Sey e get as your capacity de grow as a believer, you suppose de give 20%, 30% or 40% tithe. Sey 10% na for beginners”.

If you remember well well, Daddy GO don dey inside news for many controversial statements wey him dey make. One popular one na when him tok sey him been drink tea with God.

Whether na true sey him sidon drink tea with God or not, we no too sabi since na spiritual things. But his one about tithe don gather plenty reactions from social media, sotey popular critique and influencer, Daddy Freeze don join the conversation.

Daddy Freeze come appreciate the man of God sey “Daddy I de appreciate you as you comot apologize on the tithing topic, na courage you take apologize. And I wan also apologize for wetin I been talk against you when you first tok about the tithing, I dey sorry if my words been harsh that time”.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *