Di General Overseer of Deeper Life Bible Church, Pastor Williams Kumuyi, lead prayer for di inauguration of di 47th president of di United States of America, President Donald Trump.
This event wey happen on Monday, January 20, 2025 show as Kumuyi participate for di Inauguration Praise and Prayer Convocation wey Jim Garlow’s Well Versed World partner with, Tony Perkins from Family Research Council, host for inside Greater New Hope Baptist Church to welcome di president.
The aim of di programme na to join their faith to pray for di nation and do incoming leadership.
Kumuyi prays for unity in America
Inside di video wey dey internet, di Deeper Life G.O pray for unity, revival, and a spiritually renewed America.
Him also encourage Christians make them pursue holiness and righteousness because na wetin go contribute to national transformation be that.
In one interview wey him get with SRN just before di inauguration, him pray sey, make God almighty give Donald Trump wisdom and power wey him need to run di nation.
During him visit, Kumuyi meet with other faith leaders from around di country like Robert Pitteger, former North Carolina Representative, Lucas Miles, senior director of Turning Point USA faith and other members.