Sabi girls wey no de carry their face card game play know sey to maintain glowing skin no be moi-moi.
But some of the skincare products cost like mad, if you no get goo job wey de pay you well or you no get Odogwu silencer we de spoil you, you fit run.
Na why we compose the list of top 10 best beauty products in Nigeria in 2024 so that you no go waste your money buy wetin no go work.
Understand Your Skin Type
If you don try different skincare products, you sef go know sey wetin fit work for Amak fit no work for Yetunde, and na because, skin type dey different.
Here are the four major skin types wey dey for beauty world:
Skin Types
Oily Skin: When your face and palms de always produce plenty oil even if no use cream, you get oily skin.
Dry Skin: When your skin de always look like harmattan de happen for only your house, and you go rub cream like three times before you comot, na dry skin you get.
Acne Prone: Any small thing like this, pimples don fill everywhere for your face, chest and back.
Combination Skin: You fit get dry skin for body make your face dey very oily. This skin naim be combination skin type.
E no dey enough to use naked eye observe your skin. If you want get true result, find time visit dermatologist make them tell you the skin wey you get. Na from there you go know which product go work for you.
Top 10 Best Beauty Products For Glowing Skin In Nigeria In 2024
Cleansers
1. Simple Face Wash
This face wash get 2x more vitamin E, Vitamin B5 and some things wey go help skin barrier make your skin no dry.
2. Face Facts Ceramide Hydrating Gentle Cleanser
This face cleanser get 5 ceramides and hyaluronic acid, hydrating glycerin and skin sooting oats we go wash dead skin comot make your face dey soft.
Moisturizers
1. Beauty Formulas Brightening Vitamin C Daily Moisturizer:E get enough vitamins inside like vitamins B, C and E.
2. Face Facts Ceramide Moisturizing Gel Cream:This one go help prevent dryness.
Exfoliants
1. Face Facts Brown Sugar Body Scrub: This scrub get caramel extract wey de soften body like today bread.
Sunscreens
1. Skin Aqua Sunscreen Super Moisture Gel SPF 50+ PA++++: This one na water proof sunscreen wey no de soak water or sweat.
Serums
1. The Ordinary Niacinamide 10% + Zinc 1% : This serum get enough Vitamin B3 inside wey de help reduce yamayama for face.
2. COSRX Acne Pimple Master Patch 24 Patches: This one de work for pimple well. E de dry the pimples make e no spread for other places.
Body Washes
Dr Teal’s Glow and Radiance Body Wash With Vitamin C and Citrus Essential Oils: Dr Teal’s na ogbonge body wash for Nigeria because e dey remove dark spots from body come make body dey soft and clean.