Veteran singer and actress Onyeka Onwenu don kick bucket at the age of 72.
Onyeka wey many people sabi as the singer of “In The Morning Light” and “Dancing In The Sun” kpai after she perform on one birthday party like dat.
“It is very sad. Onyeka Onwenu just performed at the birthday of Mrs. Stella Okoli today (Tuesday, July 30, 2024), and after performing, she slumped.
“She was taken to Reddington Hospital and she couldn’t make it,”
– unnamed eyewitness pic.twitter.com/zGtY12kwG5
— Page_adventure (@Page_adventure) July 31, 2024
The birthday party wey happen Tuesday night July 30 na for Mrs. Stella Okoli and according to one person wey been dey the party, Onyeka fall down after her performance for the party.
The eyewitness talk sey “e sad sey the singer just perform for Stella Okoli birthday party wey happen Tuesday July 30 wey she pass out after the performance.
Late singer Onyeka Onwenu. Credit: X
As dem carry her reach Reddington Hospital she no come make am.
Even though the news don already travel for internet, family of Onyeka neva do any press release on top di matter wey dey ground.
As per many people favorite actress, some Nigerians don de express their sadness over her death as dem remember one of her 1999 hit songs that year wey fem title Conspiracy.