Wife of di former Deputy Senate president, Ike Ekwerenmadu don comot from UK prison according to new updates.
If you remember, them been arrest di deputy senate president, Ike Ekwerenmadu, him wife, and one Dr. Obeta for UK for issues regarding human organ harvesting.
BREAKING NEWS:
Remember Beatrice Ekweremadu, she has been released from UK Prison
She has finally returned to Nigeria pic.twitter.com/llaKxcA9Uf
— Naija (@Naija_PR) January 22, 2025
During di case of organ harvesting and exploitation involving one young adult from Lagos State, them charge di 60 years old former deputy senate president, him wife Beatrice Ekwerenmadu 56, and Dr. Obinna Obeta, 50, wey dey involve to court.
After di investigations, them sentence Ekwerenmadu to ten years in prison, sentence di doctor ten years in prison while them sentence di wife to six years in prison.
Market women jubilate at the release of Beatrice Ekweremadu
The real reasons why them release am never too clear but according to sources, Mrs. Beatrice Ekwerenmadu don come back to Nigeria.
From di look of things, she don complete her sentence wey make them release her.
In one trending video, e dey very obvious sey this release sweet her Enugu people well as many market women gather dey dance for di release.
Other people claim sey na since three months ago naim them she come back Naija.