Firefighters for Los Angeles county in California, United States of America don de try calm Californian wildfire wey don burn at least 2,000 structures for Los Angeles.
As part of their ways of helping di people, di firefighters don move over 80,000 people out of Los Angeles and other small towns make di fore no affect them.
Based on reports wey de ground, this fire don burn houses, cars, offices and other structures wey them no fit move comot for di area. The structures wey di firedon burn pass 2,000 and e still de count.
To the heroes, firefighters, and first responders battling these fires in Los Angeles: Your sacrifice and determination inspire the entire state.
California is deeply grateful for your dedication and service. pic.twitter.com/zfAzwfC1JY
— Governor Newsom (@CAgovernor) January 8, 2025
Causes of California wildfire
As people de try find out how di fire take start, di team in control of di situation don comot talk sey na “combination of dry conditions” cause am.
According to do emergency response team wey de handle di situation, them talk sey di cause of di fire no be human actions,so no be anybody fault.
Na combination of dry weather and strong breeze wey de blow for that side cause fu fire.
Celebrities affected by California wildfire
Los Angeles na home to many Hollywood stars and as this firestorm happen, some of them don lose their property in form of houses and cars. Some of di stars wey dey affected na:
Ben Affleck (actor and filmmaker), Paris Hilton (actress, businesswoman and child’s rights activists), Adam Brody (actor), Eugene Levy (Canadian actor), Miles Teller (actor)Leighton Meester (actress), Anna Faris (actress), Billy Crystal (actor and comedian),and many other people wey no dey popular.
As at now do firefighters still de try quench di fire, and them don move most of people comot for di area make them dey safe.
Authorities handling di sad incident don talk sey them de try their best make di fire no too affect di people but as e be, them no fit guarantee sey them go fit off all di fire.