Since JAMB first announce sey then don limit age wey students go fit enter tertiary institution, many opinions don de fly up and down. Na this same matter make Delta State High Court for Warri make them put mouth inside.
On Thursday October 24, Delta State High Court for Warri bin issue order to Joint Admission and Matriculation Board, JAMB sey make them no implement di policy wey talk sey unless student reach 16 years before them go fit enter university.
JAMB New Policy
JAMB bin release one statement for October 16 sey na only students wey don reach 16 by August 2025 go get admission enter university.
This statement na follow up for the new policy wey ministry of education bin introduce. Do policy talk sey di minimum age requirement for university admission na 18 years.
Later on JAMB come talk sey, small exception dey for students wey de find admission for 2024/2025 session.
JAMB Lawsuit
This policy wey JAMB wan implement no sir well with some people like John Aikpokpo-Martins, na so him carry them go court.
John Aikpokpo-Martins na former chairman of Nigerian Barr Association (NBA) and him talk sey him de stand on behalf of all do candidates wey them born for 1st September 2009 to 31st December 2009, who been pass 2024 JAMB.
John no only carry JAMB go court, him follow drag Edwin Clark University as 2nd respondent to do lawsuit.
Contents of the Lawsuit
Wetin di applicant, John Aikpokpo-Martins want na court order wye go stop di policy wey JAMB wan implement. Or make di court direct JAMB and Edwin Clark on wetin them go do.
John also de beg court sey make them issue order to do two respondents make them no withdraw di admission wey them don give Angel Aikpokpo-Martins because e go stop am from enjoying her rights and privileges. As di matter be nou, na until wen e settle naim she fit enter di school wey don give her admission.
Court Ruling
Judge wey handle di case na Justice Olotu. For him ruling, Justice Olotu talk sey make 1st and 2nd respondent maintain di admission list wey bim comot before them publish do circular wey JAMB release to Vice Chancellors, Provost and Rectors for 16/10/2024 with Red: JAMB/ADMS/139/V