Meaning of the slang ‘Ike Gwuru’

Ike Gwuru condition

Another common Nigerian slang na “ike gwuru” or “ike gwuru situation”. Depending on the matter wey them the talk about, people de use am to mean different things. For example, the way economy dey like so wey bag of rice cost pass minimum wage, na ike gwuru situation we dey so.

If you be Nigerian wey dey active for social media, you suppose don come across this particular phrase “ike gwuru” or “ike gwuru situation”.

Some of places wey you fit find these phrases na for comment section of popular blogs like Tunde Ednut page, Linda Ikeji blog or even some of your social media friends wey de like carry breaking news.

If you don de wonder the true meaning of ike gwuru, no be only you waka come, because many people wey de use the phrase no kuku sabi wetin e mean or how e take start.

Meaning of Ike Gwuru

Ike gwuru na Igbo phrase. And for Igbo, e mean sey “power or strength don finish “. But if you want understand am well, e mean sey “I don taya”.

Sometimes when people use the phrase them wan tell you sey, the matter don over them.

Another way to understand ike gwuru na this popular adage wey Nigerians de use, “water don pass garri” or “Adam go stain your white“.

So if you see person comment ike gwuru them wan talk sey the matter don taya them. And if them talk sey “na ike gwuru situation”, e mean sey, the matter na huge matter and water don pass garri.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *