Shalaye meaning

Too much Shalaye will make your face lose confidence

Wetin be the meaning of di slang shalaye wey we de see for social media all this time?

Meaning of Shalaye

Shey na plenty shalaye no de full basket? Wetin e mean when person talk this thing?
You don ever ask yourself this question?

Toh, no be only me waka come because many people dey wonder wetin shalaye mean.

Shalaye na talk wey no get head, or as Gen Z people de talk, cappings. Shalaye na cappings wey no get solid backings.

So if them talk sey person say you de shalaye, e mean sey you de talk plenty and e no make sense.

Another way to talk am na “you go explain taya no evidence”. This one mean sey, no matter how much talk you talk, e no go make sense if workings no dey.

This “you go explain taya no evidence” na Burna Boy start am for one of him clips wey him dey tell people make them make money or else them go explain taya no evidence.

So plenty shalaye no de full basket and you you explain taya no evidence na the same thing.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *