WAEC resit: Nigerians are not eligible

West African Examinations Council WAEC 2 WAEC resit: Nigerians are not eligible

Just before last year end, Head of Public Affairs for di West African Examinations Council (WAEC), John Kapi been talk sey, di examinations body don introduce new WAEC resit for their candidates.

This update na for candidates wey get one or two issues for their 2024 WAEC make them for fit fix their issues instead of to wait for one whole year to write another exam.

This update na during one morning show with Joy News Ghana na him John Kapi give am for Dec. 31 just before we enter di new year.

Nigerians are not eligible for WAEC resit

As good news wey e be, di update wey John give quickly spread like fire wey catch bush, especially for social media. Many WAEC candidates wey get issues begin prepare for di resit wey them don nickname WASSCE PC1.

Only 9 days after him first update, Kapi don comot talk sey di update wey him give no join Nigerian candidates inside, so them no fit register for di WAEC resit.
Him release this newest update in form of post wey him make for him X handle sey,

“ Please o, di news wey de go round about WAEC resit for candidates no apply to Nigerians. But anybody wey never write di exams before fit register now for di WASSCE PC1 2024 wey go soon start”.

At di end of the day, di resit na for only Ghanaian students.

WAEC resit duration

Part of di update wey John drop talk about di time wey them go start to write di exams and when them go finish.

Registration for di WASSCE PC1 2024 been start since the 31st Dec wey him first give update and e close for Jan 8. But di main exam go start January 24 and end February 15.

Candidates wey go write di exams go move go their regional headquarters go write di exams.

Eligibility for WASSCE PC1 2024

Apart from Nigerian candidates wey him talk sey them no fit write di WASSCE PC1, Kapi no talk about any other candidates from any other West African country wey no fit write di exams.

Him also talk sey people wey fit write di exams na di following:
Those wey fail one or two papers for their previous WAEC exams.

Candidates wey them been cancel their result due to one or two issues like malpractice during di 2024 WAEC.

This resit wey WAEC introduce na wetin Ogun State Academic Staff Union of Secondary Schools’ chairman, Felix Oluwaseun Agbesanura describe as a “step in di right direction”, because e go help reduce di number of candidates wey de wait for house because of one issue for their WAEC results.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *