Meaning of OG and OT

OG Kevin Ikeduba

When we dey talk about popular Nigerian slangs, OG na di OG for all di slangs. And I know sey e no get as e be wey you never hear am before.

OG na slang wey dey popular for street well well and almost everybody don de use am. Ko musicians o, ko writers o, ko Gen Z o, everybody dey use OG, but you gats be OG yourself to hear OG.

But this OG wey everybody dey use, wetin e really mean and why them the call some people OG? Na why we explain am for here.

Meaning of OG

OG na slang wey don dey in use for years like Omo werey, and e mean plenty things depending on how you use am.

OG stand for Original Gangster/Gangsta and before before, na only agberos de use am or people wey dey trenches de use am.

For the slang don evolve and now even people wey no dey trenches de use am when them wan talk about something or person wey dey original.

Social media use of OG

Even as the former meaning of OG na original gangster, nowadays them dey use OG mostly for person wey dey loyal.

If person call you OG, e mean sey you na correct person you be. And him fit vouch for you anytime.

Person wey be OG na person wey no de do mago mago, e get experience, e get connection and e de help people well well.

So if then don call you OG before, na respect them de show you be that, and e mean sey, you sef gallant.

Meaning of OT

People de quick mistake these two slangs OG and OT because of how them take sound like twins. But them get their different meanings.

OT no really get wetin the alphabet stand for but the meaning of OT for Nigerian slangs na to get update.

If person talk sey them get OT, e mean she them sabi something or them don hear one information like that.

Other times when them de use OT na to tell you sey them get wetin you de talk. As in, them understand you.

 

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *