Omo werey meaning

Omo werey receives beating

“Werey” or “Omo werey” na popular slangs wey even people wey no sabi the meaning don de use since for internet.

What Omo werey means

Werey na Yoruba insult wey mean sey the person na mad or crazy person. And the direct meaning of Omo werey na “mad pikin”

Because Omo for Yoruba na pikin and werey na “mad” so Omo werey na mad pikin.

Even though na serious insult for Yoruba, Nigerians don adopt am as everyday slang wey them dey use troll each other. Na why sometimes friends dey call themselves Omo werey. Because for inside Nigerian slangs, na normal thing.

Nigerian slangs na street language wey sometimes na different words  dey inside am. Some of these words na from native Nigerian languages them form am. Like Mafo for Yoruba and Ike Gwuru for igbo.

Others na just normal English words them take form the slangs. Even though the spelling fit resemble with the normal English, them fit mean different things.

For English, Brother Bernard na person name, but for Nigerian slangs, na when person do mistake fall for ground.

Just like every year, this year Nigerians agree sey, their theme na no gree for anybody. This one mean sey, an eye for an eye. And since the year start, na so so different slangs and phrases the comot for the country.

 

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *